Pidgin PoetryPoetry

Open Letter to Rapists

Una wey konji dey hol, how market?
Shebi una dey use Aunty play una antics,
Una well done o!

Konji no be bastard.
If konji hol you,
E mean say, ‘body no be firewood’.
Konji hol you no mean say
Make you hug am.

Konji hol you no mean say
Make you loose guard enter person pikin.
Konji hug you no mean say
Make you marry am.

No dey ‘access’ person pikin like say na bank,
Reason this mata well well.
This tori no dey sweet us yan,
But as the mata be ehn, we go yan.

Resist the urge now and
Resist the urge to 𝘴𝘩𝘢𝘭𝘢𝘺𝘦 later.

Why not share?
Tags

Related Articles

Leave a Reply

Check Also

Close
Back to top button
Close
Close
error: Alert: Content is protected !!